AIDS: Bros na wah for you oo, you just come everybody they fear you like death, where you get ur own from.
EBOLA: Ha ha ha, I been tell u that time naa, say make you wait ,make you neva commot, you no gree, u rush come out, e no tey doctors tidy you...but see me now, the patient dog, eats the fattest bone.
AIDS: na wahoo, everybody dey fear oo, no body dey near person wey you catch oo, but me, if i catch someone, no one go send, people go dey even chop wit am, hug am, even 'sleep' with am sef, without issue.
EBOLA: Bros i ready come, u know native doctor where do dis juju for me? I dey pursue somebody self even if him don die...u no fit carry person wey I kill from state to state like that oo.
AIDS: Even hospital sef dey fear you oo, if dem carry your victim come hospital, d hospital don close be that, bt me, everybody go dey go normally like say i no dey there sef.
EBOLA: Bros, no be me do u oooooo, na only you waka come naaa.
AIDS: Your case tire me ooo, I wan be like you oo, you just make me look like nothing me dey fear you cos you fit catch me self........but know sey, all these Virus you are sharing, remember that 'diaris God oooooo....
I know for sure that very soon EBOLA will be a thing of past by God's grace..
No comments:
Post a Comment